Falz – Church Mind Lyrics

Falz – Church Mind Lyrics
Church Mind
Falz, Priesst & Kurdi Klymax
    Lyrics copied!
    Church Mind Album Art
    "Church Mind." - Falz, Priesst & Kurdi Klymax

    Album: Break Time
    Track No: 02

    Baba dey Jaiye for Lekki
    Omo dey suffer for trenches
    Bukata wey dey hold omo for neck
    This one na baba Ozempic
    Sapa olympics
    Gbadura, Oluwa will fix it

    Padi want secure him pocket alone
    Ojukokoro turn am to pick me
    Everybody getti freedom of foolery
    Brotherly, abegi feel free
    Zero Zero 1234
    Take my AZA Oya credit am

    At all at all na eem bad pass
    Shey na why dem dey call am abegistan
    O ri quick bag o ti loose guard
    He go kiss feet he go lick nyash
    See shit for him mustache
    Please keep your distance

    Many things wey
    I no wan try
    Many things wey
    Shima wan buy
    I want go heaven
    I no wan die
    Wickеdness dey
    Inside church mind

    Oh my God what is this
    Yahoo boy dеy shout thief
    Everybody dey collect
    Cobhams gan dey see things
    My baby say she wan wig
    She don dey gum body since
    No fit tell her say I no guide
    Now that kind thing dey kill steeze
    As long as you dey alive
    I swear to God you don die
    Money can’t buy happiness
    Wetin poverty go fit buy?
    Olopa conclude I be criminal
    Shey na dada be person crime?
    I no look like wetin I dey face
    Omo thank God say person fine

    Ye leader of tomorrow see shege (shege)
    Leaders of tomorrow still dey wait (wait)
    Leaders of tomorrow don dey old o
    Grandpapa dem still dey race
    Be like the tomorrow don dey late
    All of my padi dey relocate
    Leaders of tomorrow don dey craze o
    Wetin dey happen nau kileleyi, kileleyi?
    Many things wey
    I no want try
    Many things wey
    Shima want buy
    I want go heaven
    I no wan die
    Wickedness dey
    Inside church mind

    People dey suffer but pastor dey tell us to pray
    They teach us to never complain
    If you get problem, don’t bother to tell anybody
    Say Jesus will show you the way
    They talk say the dread wey I carry for head is blocking my blessings
    Yet, politicians wey dey thief dey pay tithe and offering
    Call him a saint

    Poverty capital we too dey suffer but we no dey feel am
    We feel say na norm
    Police go stop you for dripping for Lagos
    Dem fit to shoot your papa with a gun
    I hear say EFCC don dey raid
    I’m not a scammer but still l go run
    This na the life I dey live for Nigeria
    Yet nobody get mouth to talk say e wrong
    Like bro what the fuck?
    Ahh

    Writer(s): Falz, Priesst, Kurdi Klymax.

    All lyrical content displayed on this website is the intellectual property of its respective copyright holders. No ownership is implied, and no copyright infringement is intended.

    Get the Latest Lyrics Updates!

    Subscribe now and never miss a new song lyric update.

    Failed to load audio, please try again later.
    Failed to load song data.
    Invalid email address entered!
    Enter your suggestion!
    Thanks for your suggestion!
    Link copied
    Stop & exit Playlist

    Suggest a Lyrics Edit

    Stop Song
    Rhyto-Artwork

    Church Mind

    Rhyto
    × Add Rhyto to your Home Screen!